+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Catch Woman Wey Plan Her Kidnap For Edo State

One woman wey dey work for one company for Benin, Blessing Ogunu nai Edo State Police Command don arrest join with two pipo cus dem go plan kidnap to take play Bliss Legacy Limited wayo to kolet moni.

Na for 23 March 2024, nai one Samuel Prince Omomuzo wey dey stay for No 102 for Ihama Road inside Benin City go report for police say pipo don kidnap one of dem staff member.

Na for di way nai di kidnap pipo take say Dem want N4,800,000 as ransom bifor dem go release Blessing Ogunu.

As investigation dey go on, nas police get to know say na Blessing nai plan hee own kidnap join with Esther Anthony and Ukpebor Joel.

Wey police dey ask kwestun, Blessing say na cus Bliss company wey she dey work for nor gree give land to customer wey don already make payment for land, nai make she plan hee own kidnap.

Police still dey ontop di mata and dem go soon karey di teree of dem go court

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM