+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Don Free Di Women Wey Lead Alarm Blow Protest For Niger

Di teree women wey gada ginger put for pipo mind for Minna, Niger State make dem go protest against govimet di way food price take dey go up for di kontri, police don free dem.

On Wednesday nai police arrest Aisha Jibrin, 30 yrs, Fatima Isyaku 43 yrs and 57yrs Fatima Aliyu say na den be di mastermind wey push for di food protest.

But on today Thursday Omoyele Sowore, wey be ACC presidential candidate and still di pesin wey start #RevolutionNow say dem don free di women.

Yesterday we bin tell you say Sowore dey shout for X why Police for Niger State go arrest di teree women and some other pesin.

He come tell police make dem quick go release di women wey just dey protest for wetin dem go see eat.

Thursday morning, Sowore come give update say “FREE AT LAST: Di heros of Niger. Teree women wey dem arrest cus na dem dey in charge of alarm blow protest for Niger State, Govimet of di state, Govinor Mohammed Umar Bago confirm say di women don free.

“Make Police beta stop all di rubbish wey dem dey karey dey arrest pipo for di kontri.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM