+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Hand Don Touch Naira Marley Cus Of Mohbad

Lagos State Police Command, on Tuesday nite say dem don catch singer Azeez Fashola aka Naira Marley, wey go epp dem for investigation for di kpeme of hin foma record label singer wey don die, Ilerioluwa Aloba, aka Mohbad.

Na di tokpesin of di command, Benjamin Hundeyin, nai write am tok for dem X handle wey be foma Twitter.

He say: “Azeez Fashola aka Naira Marley don dey awa hand for kweshun and ansa and any other tin wey go epp us know about di death of Mohbad.

Before di arrest on Tuesday, that same day, Naira Marley don bin write for X say hin don land Lagos to come epp police for investigation.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM