Police don sieze one Toyota Sienna motor wey get plenty hard drugs wey dem dey do stop and search along Ozoro-Oleh express but di driver pick race enta bush.
Wetin dem see inside di motor with registration nuba FST 242 YK, around 4 for morning na codeine, tramadol, swinol, manG, and vega.
SP Bright Edafe, say dem dey try to katch di driver wey run but di same June 14 nai hand touch two pipo wey dey tiff for Ughelli thru di epp of Command Anti-Vice Squad (CAVS), join with Ughelli Vigilante Group.
Na info nai di police take reach Okorodafe around 4:30 for evening, arrest Moses Francis wey be 29, na hin come confess say na dem go tiff for Aro Street bifor he show police di place wey anoda gang member Cosmos Erueseke, 26 years dey hide.
