+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Una Salary Big Pass My Own— Gov Oborevwori To Perm Sek

For di opening of 12 four-bedroom duplex wey Govinor Sherrif Oborevwori dey give Permanent Seketary on Thursday for Asaba, nai he say na N503,000 he dey kolet as salary permanent seketray dey kolet N900,000.

No be only house nai dem kolet as di new Permanent Seketray still get new motor as dem don dey complain bifor say Directors moni big dem own.

Govinor Oborevwori still say dem dem don give 302 opurtuniti to buy moto thru Public Officers Vehicle Loan Scheme, then 119 pipo don benefit from di Public Officers Housing Loan Scheme, and dos wey wan don farm work dem still empower dem.

E nor end there cus 450 senior management staff get support to go do seven-weekend training program wey dem colabo with Administrative Staff College of Nigeria, join with oda tins.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM