+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Immigration, EFCC, DSS Find Yahaya Bello As He Turn Wanted Pesin Cus Of Fraud

Di foma govinor of Kogi State, Yahaya Bello don enta black book as Nigerian Immigration Service don put am for dem wanted list of pipo wey nor go fit travel komot from di kontri.

Comptroller-General of  Immigration Kemi Nandap, thru di Assistant Comptroller of Immigration, DS Umar, say make all security pipo join with DSS nor allow di foma givinor run, anywhere dem catch am, sharply areest am.

Bifor dis Immigration notice dey come, EFCC don already bin go display Yahaya Bello for dem Facebook page say na wanted pesin as he run komot from arrest on Wednesday.

Know say na on Wednesday nai EFCC block Bello hass for Wuse, Abuja to arrest am cus if N80.2 billion fraud case but bifor you know di man don escape.

Tok come full ground as some dey say nor be EFCC nai come arrest Bello cus one judge for Kogi say maks dem nor arrest am while Attorney of di Federation say make dem arrest am.

Mata wey dey drop now be say even di Inspector General of Police, IGP, Kayode Egbetokun, don tell all police wey dey work with Bello to return back to station.

Wetin dey fly waka now be say na for Kogi State Govinor Lodge nai Bello dey hide put.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM