+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Porchu PDP Lawmakers Wey Court Sack With Teargas

Lawmakers for Plateau State Peoples Democratic Party wey court serve breakfast make dem nor be lawmakers again, police don use teargas porchu dem from Plateau State House of Assembly.

Na 16 lawmakers nai Court of Appeal sack for Plateau and all dey under PDP.

Before you say jack, naso di lawmakers come di House of Assembly Complex, say dem must enta folow for di sitting.

Wetin Daily Post first drop be say di lawmakers wey don already dey binu, reach Rayfield Old Govimet House in di morning with dem supporters for back as dem dey shout say dem must sit for di plenary.

So that gbege no go bust everywhere cus tension don already dey spark nai police and other security wey reach di place no allow di sacked lawmakers to enta but still dem stand nor wan gree move.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM