+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Ready To Pay N1m For Who Find PrimeBoy

Lagos state police command say dem dey find Owodunni Ibrahim aka Primeboy afta dem don invite am since make hin come to ansa kwestun about Ilerioluwa Aloba aka Mohbad wey die last month.

Tokpesin for di Lagos police, Benjamin Hundeyin nai write am for X say Primeboy don turn wanted pesin, come even describe am as say hin tall reach 1.64-m, na black man with mark for face and na Yoruba pesin.

Hundeyin say di last place wey Ibrahim dey stay na 3rd Power, Oke Eletu for Ikorodu.

Say if any bodi see am make dem rush go any police station or call 0803 688 5727

Di tokpesin say di Commissioner of Police, Idowu Owohunwa don put N1,000,000 ransom to give anybodi wey fit lead Dem to arrest Primeboy.

Before now di tokpesin don bin write for X say dem don arrest Naira Marley.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM