+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Tear Race

Nothing less than 167 police officers nia gbes comot from one training ground after dem hear say dem dey receive training so dat dem go go gbege Boko Haram badoo dem.

The officers wen borrow leg so wen d force don declare wanted dey amongst the 2,000 additional police officers wen d Inspector-General of police Ibrahim Idris recently draft to support the efforts of the military against d boko haram jaguda dem for d North-east.

The officers no gree submit their arms, ammunition and other official equipment wen dey wit dem when them dey tule.

The force been send dem go for one induction training for the Nigerian Army Special Forces Training School for Buni Yadi, Yobe State. But many of them come start to dey fly after dem find out say na Boko Haram fighters wen no get conscience nia dem go go kira wit.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM