+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Poor Man Nor See Food Chop – Ibadan Youth Protest

All di take am easy wey Nigeria govimet dey base on di different protest wey dey hapun for di kontri, nor dey enta kontri man head again cus anoda demonstration hapun today for Ibadan, Oyo State as many pipo dey cry for di hunger wey dey show dem shege.

Di protest pipo dey beg President Bola Tinubu make he do sumtin about insecurity join with di alarm tear wey dey show kontri pipo.

Na young pipo nai plenty pass for di protest, dem say wetin dey hapun for di kontri don belle full dem , so make Govimet shake bodi for gud.

Even police dey ground so that di protest nor go turn to gbege, cus dem karey paper write, di poor nor fit chop, Tinubu nor forget wetin you tell us.

This is happening few weeks after residents of Kano, Niger, Lagos and some other parts of the country took to the streets over economic hardship in the country.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM