+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

President Buhari don create scheme for young farmers

President Muhammadu Buhari don tell agencies wen dey involved for agriculture make dem include the youths even as dem dey use modern methods of farming, he come tell all those wen dey interested say dem go get better environment so dat everything go go well.

Wen oga Buhari dey yarn on Tuesday for Abuja during the launching of d National Young Farmers Scheme wen the National Agricultural Land Development Authority (NALDA) arrange to take increase youths their interest for farming, he come talk say na agriculture nia still remain the backbone of the Nigerian economy, unto say na him be the largest contributor to Naija Gross Domestic Product (GDP).

He come talk say the NALDA wen dem don wake up again go make Naija food boku and say in some few years time we go begin dey make more money from agricultural products wen we go dey export.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM