+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Primary Children Burn Skool, Police Arrest Dem

Two small children don land dem sef for police net for Ogun State afta dem go burn di Community Primary School wey dey for Isheri Olofin, Ifo Local govimet area yesterday Sunday.

Di children na just 6 years Wahis Musa and 9 years Malik Iliasu and na di community skool wey dem burn nai dem dey go.

Report wey di tokpesin of di command for Ogun State tok, Omolola Odutola, na Ojodu-Abiodun Divisional Police Officer nai arrest di small piken dem.

Di tokpesin say na one chief from di community nai go report for police station say Wahis Musa and Malik gained enta di skool through one class wey dem nor lock, gada all di books wey teachers and other skool children level come burn am.

Na di Anti-Crime team and police detectives come rush reach di skool to really go confirm, naso dem jack children go police station make dem ansa why dem burn di skool.

Investigation sha don start to know weda na only di children karey dem hand take go burn di skool or pesin nai send dem. And police don dey try to call di mama and papa of di children.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM