+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Protect Yasef Against Dengue Fever —NCDC Advise Nigerian Pipoe

Nigeria Centre for Disease Control and Prevention (NCDC) don warn  Nigeria pipo especially di ones wey dey stay for Sokoto to take care of demsef make dem nor go catch dengue fever.

This new fever wey dem dey call dengue just come out all of a sudden and na from mosquito bite e take dey enta pesin bodi.

Di dengue virus dey stay for inside mosquito but e never dey sure if di virus dey pass from human being to human being.

Di sickness never get any treatment for now wey dem dey use cure am.

NCDC say since dem know about di outbreak for Sokoto on Saturday dem dey warn pipo to dey careful.

This na wetin dem write for dem website, “Wetin we don know be say how to prevent and control dis dengue virus depend on di vector. Treatment nor dey for dengue. But if pesin quick know and start treatment e dey epp resuce kpeme.

“From di look of tins, dengue fit dey serious sotay di pesin fit die. Di symptom dey start from four to 10 of pesin catch di virus and e dey last two to seven days.

“Symptom wey di fever dey karey na, high temperature of 40°C/104°F, strong headache, pain inside eye, muscle and joint pains, belle go dey turn pesin, vomit, swellup throat, and rashes. Pipo wey di di dengue don catch for two times nai dem risk high pass.

Di agency say symptoms of di fever fit serious or nor fit seriously for some pipo and before one week or two weeks do pesin go well.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM