+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Reduce Food Price Before 7 Days Finish–Court Order FG

Lagos Federal High Court don give match out order to Federal Govimet to make food price and other tins for di kontri wey dey rise up come down before seven days go finish so that di poor man fit breath.

Justice Ambrose Lewis-Allagoae nai be di judge wey human right lawyer, Femi Falana karey di mata go meet say na die nai Pipo dey for di kontri.

Falana say na since 2023 nai e karey di case come against di price control board and attorney-general of the federation but since then Dem never show face for court.

So in Wednesday wey Justice Ambrose dey give di jorjimet he say wetin Falana bring come na true as e folow di law of price to take control food.

Naso di judge say before seven days go finish make govimet put new cheap price for milk, flour, salt, sugar, bicycles, okada, motor and di spare parts.

Join with fuel, diesel and kerosene so that tins fit easy for di ordinary man.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM