+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Release the barber wen una arrest-Abba Moro

The Senator wen dey represent Benue South Senatorial District for the National Assembly, Abba Moro don begin dey ask for the unconditional release of Elijah Odeh, one young barber from him constituency wen dem hold for Kano State becos of hairstyles wen he barb.

Wen Moro dey yarn for one statement thru him media office for Abuja on Sunday, he come talk say dem arrest the barber becos he barb different hairstyles for him customers, when according to dem na offence to Islam.

Moro come talk say na one group of muslims nia arrest Elijah some few days back becos the hairstyle wen he design for d head of two of him customers na insult to Islam and the Holy Prophet Mohammed (SAW).

He come talk say dem no gree give d man bail undermining say the Governor of Benue State, Samuel Ortom, and Kano state Governor, Abdullahi Ganduje don shook mouth put for d matter.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM