+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Remove Fake News About Me Or —DJ Switch Tell Blogs

Mata blow for many blogs yesterday, Wednesday say Catherine Obianuju Udeh aka DJ Switch, police don arrest her cus of di way di DJ go dey curse and tok to Nigeria police anyhow.

Di tori tok say na on Monday nai di tin hapun for Elemoro, Ajah inside Lagos State, as gbege bust out cus di DJ go dey curse woman police officwr wey dey on duty and di case reach fraud mata.

But mata don turn as di DJ don come out say she go shock all di pipo wey karey di fake news.

For statement wey DJ Switch bring dis morning nai she take say na from sleep pipo take dey call her say dem arrest her and di tin dey very embarrassing and shocking for her.

She say she nor dey look for any kind cheap message to sell her cus wetin di blogs dey find na make pipo gada for dem site.

DJ Switch say her lawyer don karey di mata and if all di blog nor come tell her sorry and komot di fake news bifor today finish, make dem ready to go court.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM