+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Resin EFCC Call Zenith, Providus, Jaiz Banks Ogas For Betta Edu Wahala

Di Chief Executive Officers and Managing Directors for Zenith Bank, Providus Bank and Jaiz Bank get some kwestun and ansa to do for EFCC cus of di N441b wey dey find say e connect to Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation.

Around 4:55 on Tuesday evening nai di three bank ogas dey for EFCC headkwata for Jabi Abuja dey ansa mata.

Even di coordinator and chief executive of officer for National Social and Investment Programme Agency wey dey inside Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation still dey get am for EFCC hand base on moni of N44bn.

One Oyewale for EFCC nai confirm di arrest of Zenith, Providus, and Jaiz banks oga, say dem dey ask dem kwestun wey concern  ₦44.5bn wayo wey dey for di ministry and e concern Edu and Shehu.

He say dem don release Halima Shehu but she still dey ansa dem kwestun and she go dey come every day till di investigation finish.

“About di report for di ₦44bn and ₦30bn di commission still dey trace am, her agency dey under di Ministry of Humanitarian Affairs too.

“Plenti moni dey involve cus di work of di ministry na to epp. Nai make we nor fit put hand to all where di moni enta but wey still dey trace am.”

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM