+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Beta Edu Nor Fit See Presido, Ready To Enta EFCC Office For N585m Wahala

Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Dr Betta Edu, go ready to face EFCC today for how she take use moni  pass for her office.

President Bola Tinubu don bin suspend her tru di Special Adviser on Media and Publicity, Ajuri Ngelale then tell EFCC make dem do investigate ontop di N585m wey get kleg waka from di ministry.

Afta Presido suspend Edu with many tok from pipo and PDP, di Minister come go presidential villa to go see President Tinubu but security nor allow her enta.

Nai Presido set up one panel wey di Coordinating Minister of di Economy and Minister of Finance go dey togeda so that dem fit check di social investment program well and let pipo mind come down about di program say e fit still get head.

All di mata bust out about di 37 years old Edu afta memo leak wey she tell di hakatant general of di federation, Oluwatoyin Madein, to transfer N585m go  one private hakat of one Oniyelu Bridget, wey dem say nai be di Project Hakatant wey dey give grants for Vulnerable Groups.

Di N585m Edu say na for pipo wey dey sukpa before dem fit chop for Akwa Ibom, Cross River, Ogun, and Lagos states, nai get am, and all dis tok wey dem dey put for her head nor be true.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM