+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No Dey Kolet Dollar For Wetin You Dey Sell Or See Yoursef For Jail

Big warning nai EFCC don troway give pipo wey dey do business on Monday say dem nor wan hear or see say dem use dollar as means of exchange for any goods and service, pesin wey nor hear go land for jail.

Na for dem latest edition of dem monthly e-magazine nai di chairmo Ola Olukoyede, take say anybodi wey dem catch dey use any foreign moni take dey sell business or kolet for business dem go see am s tiff.

EFCC nack di warning to schools, hotels, supermarkets, estate developers, and all di pipo wey dey do one or two business to dey very careful.

Di Oga of EFCC say dem fit troway eye for cases where foreigner come and na only he debit card or dollar nai e get, but di pesin go make sure e document am very well or na kirikiri.

Naso Olukoyede take say make pipo dey very careful cus di kontri moni nor be dollar but naira.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM