+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Senate Swear Yohanna As Adamawa North Senator To Abbo Seat

On Wednesday di Deputy Senate President, Jibrin Barau, don swear in Amos Yohanna to be di new senator wey go rep Adamawa North Senatorial District.

Yohanna na PDP member wey take over from Elisha Abbo afta Court of Appeal sack am last week Monday.

INEC bin say na Abbo nai win di election wey dem do for February 25 but Yohanna nor gree, hin karey di case go tribunal but he no still win for tribunal.

Nai he run reach go appeal court, na there di three-member panel wey Justice C.E. Nwosu-Iheme lead, come tell INEC on Monday say make dem quickly go give Certificate of Return to Yohanna cus na him really win di election to enta National Assembly.

As Abbo hear di judgement of di appeal nai he say na  Senate President Godswill Akpabio nai make court sack am as senator.

Afta di next day nai di same Abbo come out to tell Akpabio sorry say hin see say di president hand nor dey inside of he sacking.

[Punch/SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM