+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Sinach New Single, Enta Boomplay and YouTube Today

Popular gospel singer, Osinachi Kalu Okoro Egbu aka Sinach don bring new song title Remember come out today Thursday, December 28.

Di song na prophetic theme wey go dey tell pipo about how God great and na for Boomplay and YouTube nai e go take come out.

With wetin Sinach tok, Remember nor be just music, but na way to take remind us of how God nor dey fail and all di blessings wey he don sama for di year 2023.

As pipo wey believe God dey ready to tell 2023 bye bye, Sinach’s Remember song na to encourage dem make dem to enta 2024 with hope and nor say Gid nor fit fail.

She tok say “Dis prophetic anthem go dey for di mins of pipo wey believe, to be reminder say God dey too good and notin hard for am.

Di song Remember, get beta melody and di lines make sense too, so for fans and pipo wey dey follow Sinach  beta melody to touch mind don land.

[The Sun/SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM