+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Singer Zahara From South Africa Don Die

South African singer Zahara, wey don win plenty award, don die according to tori wey drop on Tuesday.

Na for November nai di family of di singer come out to say dem karey her go hospital cus of pains wey she dey get.

Her manager Oyama Dyosiba come tok fro social media say make her fans dey pray for her as her condition be one kind.

Zahara real name na Bulelwa Mkutukana and dem born her 1987, only she nai teach hersef how to play guitar. For 2011 nai she come dey reign with di song Loliwe, di song even be win Album of di Year for South African Music Awards.

She come even do di song for Nelson Mandela for he hass 2013, before di man die, afta he die nai Zahara come write one song for di leader wey she sing for Xhosa and English.

For 2019 nai Zahara come out tok say she nor dey see eye komot from where ogogoro dey.

Naso di tin hard sotay she come get liver complications wey come kill her for hospital inside Johannesburg on Monday nite.

Her family sha never bring official statement but pipo wey like her nor fit hold di cry again as all don rush enta social media di remember her happy times.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM