+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Generator Smoke Kill Boyfriend And Girlfriend For Warri

One man and him babe don die early mormor of Monday for Ugborikoko Community wey dey inside Uvwie LGA.

Before di lovers die di man don bin do big birthday celebration for di girlfriend inside one nite club.

Tori say afta di boyfriend and girlfriend komot from club finish nai dem go di babe store.

Na inside di store nai dem on generator kip pass there sleep go, before day go break dem don already die.

On Tuesday nai di Delta State Police Public Relations Officer, DSP Bright Edafe confimate di tori for Warri say di lovers don really die.

Some pipo wey dey sorry for di whole tin wey happen, dey say na enemies nai put hand for wetin make dem go on generator inside.

While others dey blame dem say na only dem use hand karey death draw bodi, come dey give pain to dem family.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM