+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Sirika Come Tell Us Wetin How You Use N8bn Take Do Airline Wey Nor Dey, EFCC

Di bifor Minister of Aviation, Hadi Sirika don enta EFCC hand as dem dey ask am wetin hapun to Nigeria Air wey di ministry launch.

Na on Tuesday nai dem karey Sirika reach di headkwata of EFCC for Abuja, to go kwestun and ansa di foma Minister.

Wey one EFCC source dey confam di arrest, he say na cus of di aeroplane wey Nigeria nor use eye see or where e even fly go nai make dem bring Sirika to come ansa kwestun.

Di source say though say di agency never really knows di total moni wey dey for di project but Sirika dey tok and dem go use am take charge am to court next week.

he ex-minister is being charged with Na 8,069,176,864.00 billion naira nai dem dey charge with first say hin karey di moni put for hin younger broda leg, Abubakar Sirika, wey dey work as a level 16 Deputy Director gor Federal Ministry of Water Resources.

Di Abubakar tok say he get company, wey he launch di moni enta to build runway for di project.

Bifor now Hadi Sirika don bin boast tok for Arise TV interview say notin like say na N8bn be di project moni but na N3bn nai govimet give wey dem use to work di project wey Nigeria pipo nor karey eye see.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM