+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Social Media Law: Make Una Nor Fear, FG Tell Nigeria Pipo

Federal govimet say make pipo nor get fear or shaking about di law wey dem wan put for social media so that fake news go stop.

Na di Minister of Information, Mohammed Idris, nai dey tok for interview for Abuja say make Nigeria pipo nor fear but dem own na just to dey tok true all di time.

He say na we suppose stand for front dey tok true every time and make nor bodi dey karey fake news for head, cus di problem wey fake news karey nor be here.

Di minister say nor bodi go like make dem scatter hin house or kontri cus of news wey be fake, so make nor bodi encourage am at all.

“I don tok am before say make pipo dey careful di way dem dey go about investigation. We know say we nor want fake news.”

Idris come still say di social media dem still dey use am to spread current news, so make pipo follow di positive part. And dem go work with international community on top di mata.

“Make all of us put hand togeda to stop all this tok of fake news and we got do am without say you nor match pesin for leg, so that press go get freedom.”

[NAN/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM