+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Speak Igbo or Yoruba Nor Go Open Door Likw Global Language Go Do— Kilton Cod Back Peter Okoye

Di tin wey singer Peter Okoye tok for X say who Nigeria language don epp since den dey karey am for head cus for am na only English and French he shidren dey speak wella.

Naso pipo start to blast Peter say why he go spit dat kind rubish but Kilton Cod don back am say make nor bodi yab di singer cus even hin own papa don ask am why he shidren dey speak only French and English.

He say ” I don argue same tin with my papa many times cus dem go dey say why my childfen dey speak only French and English and nor sabi Igbo? Me dey yarn dem say di world dey move and you nor fit use Igbo or Yoruba for white man land unless dem wan go be Yoruba or Igbo film actor.

“Dat one nor mean say if i get chance to teach dem Igbo i nor go do am but i go chopse language wey go epp dem life for future more dan anytin.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM