Supreme Court don put final stop for all di argument wey dey for di election wey karey Bala Mohammed put as Govinor of Bauchi state.
Na Justice Ibrahim Saulawa nai read di jorjimet for di case wey Sadique Abubakar bring come and dem say e nor get any beta stand.
Remember say e never tay wey di Supreme Court just stamp Govinor Babajide Sanwo-Olu as di real real govinor for Lagos.
[SA]