+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

T inubu Certificate Mata Don Worse Bad Name For Nigeria – Peter Obi

Peter Obi of Labour Party say di certificate wahala wey dey happen for dis President Bola Tinubu issue don turn to anoda tin for di face of di kontri sotay e nor fit race face again.

Obi for di press conference wey he do on Wednesday for Abuja say di way dis certificate mata dey go just dey touch every Nigerian both do one wey even dey obodo oyibo.

He tok say: “For pipo wey dey outside, dis Chicago University mata plus Chief Bola Ahmed Tinubu many problem of who hin really be, don make mata worse as Nigeria name don kpafuka.

“Bad as e be pipo for outside dey see Nigeria as 419, wayo certificate, tiffing of anoda pesin name. All dis tins nor just makes sense cus we for fit stop am make e nor happen.”

Remember say Atiku Abubakar of PDP nai bin go meet CSU through court, without President Tinubu knowledge make di skool bring Tinubu result.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM