+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Teree Men Die Inside Pit Toilet, As Dem Det Try Pick Phone

Fear catch pipo wey dey stay for Yar’Gwanda village inside Tsanyawa LGA for Kano State afta one 60 years man, hin son and one other man die inside pit toilet as dem dey try pick phone.

Wetin di Public Relations Officer of Kano State Fire Service, Saminu Abdullahi tok on Monday be say said na around 11 on Sunday morning nai dem station for Tsanyawa get call from one Aminu Yar’Gwanda say four pipo nor fit come out from pit toilet.

He say Malam Danjuma go toilet he phone come fall inside di pit naso he come dey try pick am, come fall enta.

As di Malam 35 years pikin, Ibrahim, see say hin papa nor fit come out nai he dive enta di pit to bring am, but naso he lock with di papa inside di pit toilet.

As Aminu Gaye, 35 years and Abba Alasan 28 see say di papa and pikin nor for come out nai one jump enta, di oda one follow but all di four of dem nnor get way to come out.

Wey fire service come reach there around 11:15 that morning di first teree pipo wey dem bring come out don already dey unconscious, na only di fourth pesin Alassan nai still dey alive.

PRO Abdullahi say dem karey di pipo give di  Superintendent of Police for Tsanyawa Police Division, Oro Lado, na from there dem karey to Bichi Specialist Hospital wey dokitors confam say out of di four teree don die na only one still dey alive.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM