+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Nor Porchu Any Bodi From Supermarket, Chinese Chamber of Commerce For Abuja

Afta many pipo don dey complain cus of di way wey di Chinese supermarket for Abuja take porchu say dem nor want kontri men to enta again, di China General Chamber of Commerce don come tok dem own side.

Na on Sunday nai one video dey waka say di Chinese supermarket wey dey for Royal Choice Estate along Airport Road for Abuja, nor gree allow Nigeria pipo enta to buy food stuffs for di store, wey come make pipo dey vex why dem go dey do dat kind tin for anoda man land.

But on Monday nai di chamber come out tok say di Chamber of China dey inside Royal Estate office side and di supermarket too.

Dem say pipo dey stay di estate and na dat side nai di supermarket dey and dem get estate rules but di Chambers of Commerce dey anoda side.

China Chamber of commerce say notin like say dem porchu anybodi and di problem wey dey now go start from gate onto say security and customer nor understand demsef, cus for dem wey be Chinese dem dey treat everybodi well.

But as e dey now, di Federal Competition and Consumer and Protection Commission (FCCPC) don go ask pipo wey deg work for di supermarket kwestun to know how far, bifor dem close di supermarket.

Naso many pipo say dem like di move cus Chinese nor go fit get sumtin for anoda man land come dey tell dem where not to go.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM