+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

u Wey Nor Fit Epp Anambra Dey Tok – Onochie Blast Peter Obi

Di foma aide to before president Muhammadu Buhari, Lauretta Onochie don give gbasgbos to Peter Obi why hin go do press conference dey tok about President Tinubu certificate mata like that.

She say di press conference wey Obi karey go do for national TV nor follow at all for pesin wey nor fit epp hin own state but come out to tok against anoda pesin.

For di press conference Obi say di whole world don dey see Nigeria as pipo wey like wayo, for everytin so e go beta make Tinubu come out tok who hin really be.

But wey Onochie come write for X, na there she come troway di bomb give Obi.

“Dear Peter Obi, you just use shame karey yoursef to national TV to call di President of Nigeria, Bola Ahmed Tinubu, make hin come tok who hin be to Nigeria and di world.

“Na dis one be one of di mumuest tin wey you don do, e just bad say Nigeria dey sitdon hear from pesin wey he advisers get kolosis for head.

“If you fit come national TV, to ask kwestun about man wey all security pipo clear and even be senator for di kontri before, nai make you fail for 2023 election.

“We just dey luk well weda dem put gun for your head as you dey ask for di nuba one man of Nigeria make he tok who hin be afta security don clear am. Na only you waka come.

“Peter go house. You nor go ever be president for dis kontri. Apart from say na you take third position, you nor get wetin e take to rule di kontri, so rest.

“Di kind temper wey you get nor go fit work for Nigeria, nor be that kind leader nai Nigeria want. You fail Anambra pio. You nor even fit lead South East, under your nose South East turn to war start place.

“Place wey dey boom don scatter. Put your ojukokoro eye for one side. Wetin you dey find pass you. E nor go ever for happen.”

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM