+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Una Don Turn Nigerians To begibegi -Atiku To First Lady

Foma Vice President, Atiku Abubakar don blast First Lady, Oluremi Tinubu as she go share 100 trucks of rice give pipo wey dey stay for North.

Atiku say di way First Lady take package rice and N1.2billion share for di whole North just dey show say dem dey use food punish Nigeria make dem always dey beg.

He tok thru he Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, say dem dey use poverty to take press pipo neck instead of how to make ways easy for di citizen.

Na on Friday nai dem start to share di rice and moni as First Lady say dem dey share am to di 19 northern states plus Federal Capital Territory bifor Eid-el-Kabir go come.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM