+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Una Never See Anytin, Onanuga Laugh Atiku And Obi As US Court Nor Gree Release Tinubu FBI Report

Di Special Adviser for Information ND Strategy to Presido Bola Tinubu, Bayo Onanuga don troway body laugh dey laugh Atiku Abubakar and Peter Obi say US Court nor gree release information about Tinubu FBI records to dem.

Na for inside X nai Onanuga dey troway dis laughing bomb as hin say Atiku and Obi na just two pipo wey nor know wetin to do.

“Aaron Greenspan, di American agent and contractor of Atiku Abubakar, Peter Obi and David Hundeyin don lose to karey gbege go Washington D.C court to tell dem make dem give order to release President Tinubu FBI record. Di pipo wey dey plan don fall for gutter again.”

US District Court for Columbia don bin cancel say dem nor go release di information wey dey with Central Intelligence Agency, CIA; Federal Bureau of Investigation, FBI; and Internal Revenue Service, IRS, about Tinubu to Atiku.

Na one Aaron Greenspan nai rush bring one motion to tell di Executive Office for U.S. Attorneys make dem bring those information so that he go epp for di appeal case wey Atiku and Obi dey pursue for  Nigeria Supreme Court.

But di Judge for obodo oyibo, Justice Beryl A. Howell nor gree, hin say Greenspan nor do wetin he suppose do before he come as di court for emergency mata on Monday.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM