+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Update: Hand Don Touch Anoda Ship Wey Dey Tiff Crude For Nigeria

Di vessel MT Harbour Spirit with IMO No, 8226272 wey tiff crude oil for Bayelsa State before Tantita Security Services catch before dem karey di vessel go dem facility for Oporoza, Gbaramatu Kingdom, near Escravos full gist don drop.

Dem tok am say na around 1:00’ckock early Sunday mormor nai security take see di vessel as e just dey turn back and front around Sangana oilfield for Bayelsa, and e don already dey one of di oil platform dey load crude oil.

According to di Executive Director for Operations inside Tantita, Captain Warriedi Enisuoh, di crew for di vessel don already suck like 88,000 litres of crude before dem catch di crew.

Di head of police special task force for petroleum and illegal bunkering, Omar Sink say investigation don start to make sure say dem catch those wey dey set use di ship take dey tiff crude komot from di kontri.

Wey tori pipo come dey ask to hear from di captain wey dey di vessel plus him 12 crew members, Shittu Joseph gree say na for loading point dem take gbam am.

“We nor like wetin dey happen as we don already wan dey komot before Tantita and NSCDC come catch us.

“Teree of my crew members already don jump ent water and we never see dem till now.

“Na food as Nigeria man nai we do crew come find to eat,” wetin captain Joseph.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM