+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Video Wey Bandits Take Dey Joke With Oyibo Man Bust Everywhere

One video don dey waka for social media as one expatriate wey dey with bandits just dey laugh tok with di bandits.

Wetin one counter insurgent expert, Zagazola Makama tok be say di way di road be na for Gusau-Sokoto road nai dem take do di video.

For wetin hin write for X,  Makama say di bandit wey karey dada na bad kidnaper, Mai-Jakka wey pipo dey fear.

And di way di oyibo man be na engineer wey dey work with construction company wey dey do Gusau-Sokoto road.

As di bandits dey use Hausa take dey tok, some of dem dey praise Allah say na him dey run mata for dem, while di dada guy wey be like dem leader dey crack joke with di oyibo man as he holam for waist.

Naso di oyibo dey smile too tell di dada man make he holam well so that hin nor go fall as dem stand for di open field.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM