+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Don Komot Di Appeal Case Against Bello

New mata don show as di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, file case on Monday April 22, say dem nor want karey on with di appeal wey dem take to court against di foma govinor of Kogi State, Yahaya Bello order of arrest case.

Dem tok say resin for komoting di appe from court na join with di jorjimet wey Kogi State High Court give say make dem nor go arrest Bello.

For di notice wey di EFCC Counsel, J.S. Okutepa (SAN), sign, dem say dem gat withdraw di case of appeal cus too many waer don pass under di bridge and normally time wey dem suppose use take appeal di jorjimet, dem nor quick follw up on am.

You go remember say tok don full everywhere cus of di different jorjimet wey Federal High Court for Abuja and Kogi State High Court give about Bello, but EFCC since dem nor like di Kogi jorjimet nai dem folow Abuja court, go di hass of Bello to wan arrest am bifor di man move enta space.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM