+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We go arrange committee wey go tackle hate speech

The Minister on top Information and Culture, Alhaji Lai Mohammed say dem don arrange one committee wen go fire down wit the recommendations wen President Muhammadu Buhari approve wen go tackle hate speech and fake news.

Mr. Mohammed wen yarn dis one during one meeting wen he get with online publishers for Lagos come talk say d hate speech and fake news na twins of evil wen join together and say no responsible government go just sit down den allow that kind tin to continue to dey play.

He come say make online publishers  support the national campaign and say make dem helep to gbege dis okamuka wen he say dey worse everyday.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM