+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We go quick comot for this recession-Zainab Ahmed

The Nigerian government don talk say dem dey work on how to take change wetin get to do wit d way wen Nigerian economic take dey drop and dis one na according to the Minister of Finance, Budget and National Development, Zainab Ahmed.

Wen Mrs Ahmed come dey respond to the latest gross domestic product figures wen the National Bureau of Statistics NBS release wen show say for now, Naija dey for their second recession for inside five years, she come talk say them go restore d economy for the path of sustainable inclusive growth very soon wit d use of the Nigeria Economic Sustainability Plan.

She come talk say the country expectation of quick comoting from recession go really fast because of the different interventions wen the government introduce wen dey work well.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM