+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Return Di $720,000 Skool Fees Wey Yahaya Bello Pay, American Skool Tell EFCC

With di way di wayo case of di foma givinor of Kogi State Yahaya Bello dey go, onto say EFCC dey find am cus of di way hin take spend di state moni, American International skool wey di children dey go don say dem go return di $720,000 wey Bello pay as fees for hin pikin.

Na just some days ago nai EFCC come out to say dem just discover how Bello use $720,000 from di state moni karey take go pay skool fees for hin son and even pay ahead of small pikin Wey never wan start skool.

Wetin di skool tok for notice wey dem write go give EFCC , dem say make di agency give dem hakant to return di moni as di case don alreaddey undee investigation.

Di skool come still say na $845, 852.84 nai be all di moni wey Bello don pay so afta dem komot dem teaching moni na $760, 910.84 nai remain and dem go send am back to EFCC.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM