The Nigeria Immigration Service NIS talk on Sunday say we no get armed herdsmen for the country.
The NIS otota Sunday James, when yarn dis one for one interview wen he get with news people for Abuja, come talk say tight security don dey for d borders since the introduction of the Migration Information and Data Analysis Systems.
Wen groups like the Christian Association of Nigeria, the Yoruba socio-political group, Afenifere, the Pan-Niger Delta Forum and Ohanaeze Ndigbo come dey yarn on top d matter, dem come talk say the service no know wetin dem dey talk.