+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Woman Wey Dey Wear Human Hair Dey Shame For Demsef– Taiwo Ajai-Lycett

Ogbonge Nigeria film actress, Taiwo Ajai-Lycett, has don drop one wotoski for African women wey dey like wear wig and human hair to take make dem fine, say na low sef esteem nai dey worry all those kind women.

For interview wey di actress do with Vanguard nai she take tok her mind as she say she don dey wonder why God go give African women fine beta hair wey fit enta any style but instead na to go dey buy hair of other pipo wey nor get beta tins reach African women.

Di actress say any woman wey go choose wig and human hair, e go be say obodo oyibo life don dey hungry am and that one na just sign of low sef esteem.

“We don already dey bless with di nest kind of hair wey we fit take luk takeaway. Make we love awasef as African pesin wey we be and thank God for di finenes wey he put for awa bodi,” wetin Taiwo tok.

She come still tok about di important tin wey women dey do for di society and if pesin kip beta relationship with woman di man go get beta success and teach far for life.

As Taiwo don drop dis bomb every where just dey spark about culture and di beauty standard for Africa.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM