+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

17 Years Fake Hin Own Kidnap For Agbor

One boy wey be 17 years don land for Delta State Police hand afta hin fake say dem kidnap to kolet moni from e family.

Di young boy dey stay for Okhumera quarter inside Agbor-Obin, and na for March 20, 2024, nai he family go report give police say dem don tiff their broda.

Wetin di State Commissioner of Police, Abaniwonda Olufemi, tok wey hin dey parade di boy and hin friends for police headkwata for Asaba, he say na afta di family call di DPO for Agbor Division nai dem take start investigation to catch di teenagers.

Di police first start with di voice note wey di boy send to he sista say pipo tiff am and dem dey ask for N1 million.

As police start from there nai dem get to know say di boy range fake kidnap with him friends to dupe he family.

Wey police hand don touch di teree friends nai dem confess say dem don chop di whole N700,000 wey dem kolet from di fake kidnap.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM