+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

24 Lawmakers Wey Speaker Purse For Rivers Don Get Leg Back To Di House

Rivers State High Court don strike out di petition wey Hon. Edison Ehie bring against Hon. Martin Amaewhule and 25 Rivers Lawmakers make dem nor dey di assembly again afta Ehie say dem seat dey vacant.

Ehie tell hin barrister, Barr. Marc-Barengo make e tell di court say dem wan komot di case and really di 24 lawmakers and Amaehwule lawyers nor say no.

Naso Justice F. A. Fiberesima wey dey in charge of di case strike am komot.

As dem don komot di case that one na mean say Amaewhule and di 24 other lawmakers go kwatinue dem work for di State House Assembly.

No bodi resin say di mata go turn like dis especially wey e be say Ehie resign as di House Speaker come join with di directive wey President Bola Tinubu give Govinor Siminalayi Fubara.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM