+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Gov. Oborewori Appoint Harrysong As Executive Assistant

Gov Sherrif Oborewori don put Harrison Tare Okiri wey dey sing music and everybodi know am as Harryson as di Executive Assistant for Entertainment for Delta State.

Na for Instagram nai Harryson take tok di news ad hin dey greet di Govinor and say he go make sure to work well.

With di letter wey dem give Harrysong na 22nd of December 2023 nai di appointment take start. He come still say dem go announce di event wey dem dey ready for na Kingmaker for di 30th of March and di Sherrified and Ukodo International Festival for 2024.

Na wetin Harryson write be dis, “Di new pesin wey dey as E.A (Executive Assistant) Entertainment to di Govinor of Delta State, Rt. Hon. Sheriff F.O Oborevwori. Thank you, my Govinor, Now address call me Hon. Superstar Harrysong. I greet you specifically my Govinor as you luk me to put for dis office. Delta make una ready for Kingmaker for March 30th. Even Sherrified and Ukodo International Festival for 2024.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM