+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Armi Robbas Kill Four Pipo For Supermarket Inside One Man Village, Abuja

Four pesin nai die for di attack wey gunmen so for one supermarket wey dey for Karu LGA inside Nasarawa State.

Na on Tuesday nai di attack happen for di boundary wey near Abuja and di tokpesin of Nasarawa State Police Command, Ramhan Nansel, come confimate am on Wednesday.

Dem say na around 8:45 for nite nai dem take get info say four armi robbas dey rob pipo wey dey for Wisdom supermarket for One Man Village.

As di armi robbas dey do their operation naso dem start spread gunshot for customers, na the process of di shooting nai four pipo wey come buy sumtin for di store take die.

Even di CP of di State, Umar Nadada, dom send police me to go where di attack take happen, nd dem don karey di deadi bodi go Mararraba Medical Centre.

Di CP come still tell di Deputy CP wey dey in charge of Criminal Investigation for Lafia to go the place wey di robbery take happen make dem do beta investigation to wetin happen.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM