+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

3 Skool Of Nursing Go Epp Student For Delta State – Mrs Gloria Igumbor

Director of College of Nursing Services for Delta State, Mrs. Gloria Igumbor say na with di epp of foma govinor Ifeanyi Okowa and govinor Sherrif Oborewori wey be di speaker for House of Assembly before nai make Delta be di only state wey get three nursing skool and two midwifery for di whole kontri.

Na inside her office for new seketaria for Asaba nai Mrs Gloria Igumbor take dey tok so about how di skool of nursing and midwifery don dey take students for di State.

She say nor be small tin to take convince  Nursing and Midwifery Council of Nigeria make dem allow Delta get more than one nursing skool wey e nor be like that for other states, na her epp and govimet for di state nai make am possible and students dey enjoy am now wey everybodi wan be nurse.

Mrs Igumbor say she believe say with di M.O.R.E agenda of Govinor Sherrif Oborewori dem go get more class room did di nursing skool and di midwifery own.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM