+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nigerian FIFA Badge Referee Go Dey For CAF Women Champions League

As di 2023 African Women’s Champions League dey come for November 5 until 19 for Cote D’Ivoire, Nigerian Yemisi Akintoye dem don select am as referee wey go dey for di match.

Referee Akintoye finish skool from University of Lagos and for 2021 nai she get FIFA badge referee title before dem dey put her now join 27 other referee from other Africa kontris.

Out of di 17 referee wey dem select to dey for di Women’s Champions League, Akintoye name dey for di 12 wey dem pick.

On Monday nai Confederation of African Football, CAF, take tok am say na di Nigeria referee go work with Salma Musaganda from Rwanda wey be di first woman from Africa to do referee for men World Cup.

Akintoye don dey some other international competition like WAFU Women Champion League, Aisha Buhari Tournament, join with other ones.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM