+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

33 Aviation Directors Get Sack Letter From Keyamo

Di Ministry of Aviation just dey dash breakfast to those wey dey work for di agency, as di breakfast don reach 33 directors.

Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo nai give dis new 33 sack say dem wan clean di ministry.

Expert wey sabi Aviation say e gud as dem clean di ministry cus all those appointments na dieing minute wey foma Presido Muhammadu Buhari wan take komot nai di oga for di ministry that time, Senator Hadi Sirika pack all dis pipo put.

For May 23, 2023, only one week wey remain for Buhari to komot from power nai Sirika appoint 33 directors, new managing director for Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) and Nigerian Airspace Management Agency (NAMA).

He even put new directors for position wey nor dey exist for di ministry.

Na big shock nai enta di pipo bodi cus di sack jush coe all of a sudden afta just six months wey dem don dey di ministry.

And e never tay wey Presido send shock of sack to  some chief executives for di aviation agencies.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM