+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Robbas Attack Bank For Ekiti, Police Dey Find Dem

 

Some armi robbas go rob two banks for Ikere, inside Ekiti State on Wednesday afternoon and three pipo die for di attack.

Di robbas wey pass 20, enta di town around 4 for evening and dem use mask take cover face, dem start to dey shoot so that security and pipo around go fear before dem start to dey rob di banks.

Na dynamites nai dem take blow di security doors for di bank front, as dem enta inside di amount of moni wey di armi robbas tiff for di bank dem nor fit tok am.

For one of di bank tori say dem shoot one security die, then dem come later see two deadi bodies around.

Wetin one man wey Ade Charles, wey dey stay di area tok, “Di robbas come Oke-Osun and Oke-Ikere where di two banks dey. Dem leave some of dem gang for Ikere roundabout to dey look while di other ones dey tiff. Wey Dem dey komot dem use one black motor and okada.”

For now di Ekiti Police Commissioner, Ogundare Dare say make pipo bring dem mind come down as all effort dey to catch di robbas and make sure say dem serve punishment for wetin dem don cause.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM