+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

48 Pesin Nai Don Die For Japan Earthquake

Authorities wey dey for Japan say di pipo wey don die for afta di earthquake, don reach 48 pipo.

Earthquake hit di western part of Japan on Monday and dem don dey luk around to find pipo wey don die for inside di building wey fall and burn.

Na di city for Ishikawa Prefecture, Wajima, nai di quake touch pass, wey come bring tsunami warnings, major evacuations, and light nor come dey for some side afta di earthquake happen around 4:10 for evening on New Year Day.

Afta di  7.6 quake, nai fire start for Wajima, some pesin die while property burn finish.

Wetin Yoshimasa Hayashi, di chief cabinet seketary tok be say over 33,000 houses for Ishikawa and  Niigata Prefecture nor get light on Tuesday morning, then 20,000 houses for prefectures nai nor come get wata.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM